We’ve updated our Terms of Use to reflect our new entity name and address. You can review the changes here.
We’ve updated our Terms of Use. You can review the changes here.

Mathematics

by Blackfacenaija

/
  • Streaming + Download

    Includes unlimited streaming via the free Bandcamp app, plus high-quality download in MP3, FLAC and more.
    Purchasable with gift card

      $1 USD  or more

     

lyrics

Intro…
Omo the matter pass me oh
I solve solve solve omo
I no even get any answer at all
Abeg which which eh formula you feel say I for take
Take solve this our naija matter because eh…
e tire me

CHORUS

Solve the mathematics
What the F is this yo
Why dey trouble we so?
Oya oya
Solve the mathematics
What the F is this yo
Why dey trouble we so

Verse1
These people them bad these people them kala
Put we ina sufferation new day new wahala
Those wey dey enjoy na those way dey power
While my people gat no light no food them dey suffer
We no know where we dey go
E be like say na blind men dey lead the road
Media dey do them own
And white go turn black them want make we no know
Na which kind thing be thief I thief you dey feel my plea?
If them give them chance them go make life hard instead of make life sweet
To solve the puzzle for the bottle
We gats shine our eyes to see say politicians them wan use us die and ah..
We are the lions for the jungle
Time to fight for your rights my people make we do the maths
Oya oya

Chorus

Solve the mathematics
What the F is this yo
Why dey trouble we so?
Oya oya
Solve the mathematics
What the F is this
Why dey trouble we so

Bridge
Why we no get light ?
We na know
Why no good roads?
We no know
The budget for the projects in the projects in the ghetto when e go complete?
We wan know
Why insecurity high?
We no know
Fulani na herdsmen?
We na know
I hear some politicians are them sponsors some of them are amongst us tell me why them dey…
We wan know….



Verse2
The government this
The government that
Na their people them dey give e contract
Political appointment na their house e start
What of my brothers and my sisters ?
(My sisters…)
One Nigeria ne ‘
Ogbeni wetin you wan tell me again?
I pledge to serve my country with all my strength No go ask me wetin I gain
So wetin bring division between idomas and igbos?
Yoruba hausa dey do igbati gboos
ipob and bandits them loyal to the boss
And politicians them dey do like them no know ..them no know heh?
Why cost of living dey high ?
Why e be say na only the rich be getting by ?
politicians budget for them furniture dey cost pass our children education
make somebody tell me why ?
(Tell me why why why)

Chorus

Solve the mathematics
What the F is this yo
Why dey trouble we so?
Oya oya
Solve the mathematics
What the F is this
Why dey trouble we so

Bridge
Why we no get light ?
We na know
Why no good roads?
We no know
The budget for the projects in the projects in the ghetto when e go complete?
We wan know
Why insecurity high?
We no know
Fulani na herdsmen?
We na know
I hear some politicians are them sponsors some of them are amongst us tell me why them dey…
We wan know….


Verse3

If you ask me …na who I go ask ?
These politicians dem don Marra they don’t know how to act
If you ask me …na who I go ask ?
These politicians dem don Marra they don’t know how to act
-
Give them money to repair our roads
Wankoje
Give them budget to upgrade hospitals
Wankoje
Give them infrastructural money
Wankoje
Awonwere’ wankoje
Money wey go give my people light
Wankoje
Money wey go give my people water
Wankoje
Money wey go give my people house
Wankoje
Awoni’eranu’ Talokoje?
Charley!
These questions wey we dey ask
My people I believe say we dey up to the task
And this no be time to relax
till them politicians come up with the facts
Oya make we ….

Chorus

Chorus

Solve the mathematics
What the f is this yo
Why deny trouble we so?
Oya oya
Solve the mathematics
What the F is this
Why deny trouble we so


What….
Hardlife Na the first one ..haha
Tell them say me back with another one
What…
politicians…Ha..
If you can’t make Naija better don’t make it worse for us
Pack out, fast…
Lets us be prosperous ,ha!
Eden Kill them with the beat…
No surrender No retreat…AWOL

Till fades…

credits

released May 11, 2021

license

all rights reserved

tags

about

Blackfacenaija Lagos, Nigeria

BlackFaceNaija
The Heart and Soul of The Urban Sound Of Naija
Pioneer Of The Band Plantashun Boiz, Band Leader , Song Writer,Arranger,Performer Based In Lagos Nigeria West Africa

contact / help

Contact Blackfacenaija

Streaming and
Download help

Report this track or account

If you like Blackfacenaija, you may also like: